This edition of our ogbogen pidgin english sports news brought to you from our soft sports studio. Make e for no loss na tori wen dey totori us for world cup na we dey bring for una listening pleasure.
Fifa Word cup 2018
Una remember d guy i tell una go coach real madrid next season after the world cup.. Spain don sack the guy..E be like say madrid pass behind d FA back go sign the coach.. Well u nor fit chop ur cake still hold am for hand…
Usa Canada and Mexico don get co-hosting rights for 2026 world cup.. The three North American nations don get automatic qualification for the tournament…maybe naija go host 2050 with Ghana and Benin Republic…. I laff in pidgin, host wetin… I pray o, give me space make I laugh well. if now warri i for believe because anything is possible for warri.
Later things
If 9ja host, Ronaldo go lost